Talk about the song “My Heart Cry” Solomon Oracle said “It is a song trying to speak to my father and my maker about the struggles of life that we are facing in our generation praying that the Lord will help us not to fall despite the struggle the challenges that we are facing in our generation that he will help us not to fall”
Lyrics
This is my heart cry to you lord
Help me make I no cut the corner(x2)
Jehovah answer my prayer oh, help me Make I no cut the corner
Oluwa answer my prayer oh-
Help me make I no cut the corner
I say answer my prayer oh- make I no cut the corner
Oluwa answer my prayer oh- make I no cut the corner
Jehovah answer my prayer oh- make I no cut the corner (x2)
Verse 1:
Na beg I Dey God, Na beg I Dey beg God
Oluwa help me
Make I no cut the corner – cut the corner
I don Dey pray every day and night
I don Dey request every day and night
I am sure, you can hear me, my father- my father
Make you cut that soap for me, the same soap wey you cut for David, wey make you call am a man “after my heart”
Oluwa cut that soap for me
Thesame soap wey you cut for Solomon wey make you ask am sey “na Weytin you want?”
Papa if you ask me this kind question,
I go Dey name them one by one oh
Because my own matter I tell you sey e yapa!
Number one, I go tell you sey I need house, because my landlord don Dey loose guard,
I tell you sey I need car, because the oppression e don too much oh
Answer my prayer oh, make I no cut corner – cut corner
My father answer my prayer oh make I no cut corner!
Chorus
This is my heart cry to you lord
Help me make I no cut the corner(x2)
Jehovah answer my prayer oh, help me Make I no cut the corner
Oluwa answer my prayer oh-
Help me make I no cut the corner
I say answer my prayer oh- make I no cut the corner
Oluwa answer my prayer oh- make I no cut the corner
Jehovah answer my prayer oh- make I no cut the corner (x2)
Verse 2:
For this world wey we Dey
If you no get money you don cast
You Dey see us from above
Help us make we no fall – make we no fall
We depend on you
Na you be the Koko- na you be the Koko
Mama Dey pray every day and night
Oluwa make you bless my children
As dem Dey go,dem Dey come,
make you bless dem – make you bless dem
We don promise mama sey
We go make her proud- we go make her proud
As e dey be now
Mama don tire with that assurance –
Ayayaya
If you bless us dema know we serve a living God
Make you bless us
Oluwa Make this life begin Dey sweet us
Because we know sey silver and gold belongs to you -almighty father
Put your hand of blessing on us and bless your children
We don Dey cry
We don Dey struggle
We Dey in pains everyday
Make you
Sign am lord
Sign am lord
Sign am lord on our matter
I say answer my prayer oh- make I no cut the corner
Oluwa answer my prayer oh- make I no cut the corner
Jehovah answer my prayer oh- make I no cut the corner (x2)
I sey answer my prayer oh oh – make I no cut the corner